Connect with us

Lyrics

LYRICS: Victor AD ft. Erigga – Why

Published

on

[Intro]
It’s Victor AD na na na

[Verse 1 – Victor AD]
Bros E for better if them slap me
Say e for better make dem throw me punch
I just got back from London
Aih! my people still dey sell their vote
For bag of rice wey no carry beans
The food no go complete if e no carry meat

Aih
Before I see welcome to Nigeria
Na blackout I take know say I dey Nigeria
It’s so painful
Say the story no change at all
And it’s so painful
Say the leaders no change at all

[Pre-Chorus – Victor AD]
I believe say you get the voltage and power to rise when I fall
Na the reason why I put you there
I believe say you get everything to make this people tall
Na the reason why I put you there

And now you don dey break my heart
Say, make the people cry
No be the reason why I put you there
And if I get the power to change it, I go bring you down
But who next I go put for there?

[Chorus – Victor AD]
And I say
Oh why? oh why? oh
Oh why? oh why? oh
Eheh
Oh why? oh why? oh
Oh why? oh why? oh

[Verse 2 – Erigga]
What if I tell you ‘I was right’
And I tell you ‘you were wrong?’
That everything will be alright
But only inside my song
You will find peace of mind
Because in a crazy world
Who everybody dey call craze, na em normal

Which country for this world dey use 50 years do light
I dey London dey drive, I no even use full light
Cause everywhere bright
Even bright pass we leaders
For their mind, we be smallie with primary three reader

(?) say e dey go stadium
Na big (?)
As we dey see am so,e wear (?) for party polo
So when you feel say you dey fool us with yeye promise
We dey fool you too
Your lies dey make us wan vomit

[Pre-Chorus – Victor AD]
I believe say you get the voltage and power to rise when I fall
Na the reason why I put you there
I believe say you get everything to make this people tall
Na the reason why I put you there

And now you don dey break my heart
Say, make the people cry
No be the reason why I put you there
And if I get the power to change it, I go bring you down
But who next I go put for there?

[Chorus/Outro – Victor AD]
And I say
Oh why? oh why? oh
Oh why? oh why? oh
Eheh
Oh why? oh why? oh
Oh why? oh why? oh
As e dey pain me eh

Click to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

OUR SERVICE

Recent Post




ADS

Trending